BREAKING: Buhari don approve postponement of 2023 Census
President Muhammadu Buhari don approve di postponement of di 2023 Population and Housing Census.
Buhari drop dis update after meeting with some members of di Federal Executive Council and di National Population Commission on Friday night.
He yarn say di earlier scheduled Census wey suppose hold from May 3-7 go dey determined by di incoming administration.
FOR MORE NEWS: Charly Boy wan hold thanksgiving after hin survive prostrate cancer
Also, hin commend di methodology wey dey in place by di Commission to conduct accurate and reliable Census, especially the massive deployment of technology wey go fit deliver world class Census and laying a sustainable basis for future censuses
Buhari also direct di Commission make dem continue with preparations for di conduct of di 2023 Population and Housing Census in order to sustain di wey gains wey dey recorded and provide di basis for di incoming administration.
You fit go read di tori as Buhari approve census postponement…READ MORE