fbpx
September 29, 2024

Boko Haram: Buhari don fulfill hin promise – Buratai

buhari-don-fulfill-hin-promise-buratai

Di former Chief of Army Staff, COAS, Lt. Gen. Tukur Buratai (retd) yarn say President Muhammadu Buhari don fulfill hin promise as hin don stop Boko Haram and Islamic State of West Africa Province, ISWAP, terrorists.

Buratai, wey make di claim for interview with newsmen for Abuja, remember say President Buhari for hin inaugural address on May 29, 2015, bin promise to stop di terror groups.

However di former COAS give warning say e dey wrong to think say victory over Boko Haram terrorists means total end of hostilities. Hin tok say e fit happen again except when di terrorist groups agree to forsake dia ideology, embrace democracy, respect di national constitution and sue for peace.

Buratai yarn say right from di inauguration, di President bin get clear-cut strategies to stop di terrorists and restore peace to di North East and Nigeria in general, and hin don fulfil di promise now.

He remember say di president for hin inaugural address bin yarn say di military command centre go relocate go Maiduguri, and dem go dey there until Boko Haram don stop completely

Buratai yarn say di Boko Haram insurgency bin dey manifest before 2015 by officials negligence towards di matter.

Hin add say na that one make Boko Haram become terrifying force. Also na wetin make dem take tens of thousands of lives and capture different towns and villages for Nigeria.

You fit g read di full tori…READ MORE