fbpx
December 23, 2024

2023 elections: Buhari don lose grip of APC

buhari-dey-lose-grip-of-apc

With about three days to di presidential election, some signs dey show say President Muhammadu Buhari dey lose grip of di All Progressives Congress, APC, governors and di National Working Committee, NWC, of di party. This na situation wey fit affect (APC) during di upcoming elections, starting this Saturday.

Di clashing tune between Buhari and di APC NWC over di Naira redesign policy na first of its kind, e fit be part of why Buhari dey lose grip of APC.

Pipo wey dey take di time watch wetin dey happen, expect say Buhari wey be di leader of di party suppose  enjo di blessings and support of di party hierarchy, but no be wetin dey happen this time. Instead, di NWC has openly come out to side with dia governors against di President.

Already, Nigerians no happy because of di hardship wey Naira redesign policy of the Central Bank of Nigeria, CBN don cause.

FOR MORE NEWS: Nigeria presidential election: TY Danjuma, Christian elders don endorse Peter Obi

Remember say di APC NWC and governors of di party bin faulted di Naira redesign policy of di Buhari-led Federal Government.

According to reports,  Federal Government, through di CBN, bin resigned N200, N500, N1000 notes and dem fix February ten as a deadline to stop di use of old denominations.

ThiS policy wey di Federal Government carry come, don lead to legal battle initiated by ten governors of di APC.

Following di suit by di governors, di Supreme Court temporarily stop Federal Government from banning di use of old naira notes from February 10.

You fit go read di full tori…READ MORE