fbpx
December 22, 2024

Tinubu don call for Military collaboration for Africa

Tinubu-call-for-military-collaboration

President Bola Tinubu don call for Military collaboration for Africa, hin encourage Nigeria and di neighbouring kontries for di Lake Chad region make dem display courage in reforming dia military doctrine and practices.

Also, Tinubu yarn say di change in tactics don become necessary as kontries for di region dey battle ‘mobile and elusive irregular force’ wey disregard established rules of warfare.

Di State House release on Friday showe say na part of di President speech for Kaduna during di graduation ceremony of Senior Course 45 of di Armed Forces Command and Staff College, Jaji.

Tinubu note am say di enemies wey di kontri dey face for sub-region no be conventional armies engaging in traditional battlefield warfare.

 

FOR MORE NEWS: Ibori dey face fresh 10-year jail term, £100m seizure for UK

 

As hin dey encourage African countries to work together against common threats, di President acknowledge di multinational efforts of Nigeria, Cameroon, di Niger Republic, and Chad to bring peace to di Lake Chad region.

“We must adjust accordingly to subdue the menace. This shall require a change in mindset, strategy, tactics in, equipment and in gear. The President also used the occasion to spell out his National Security Objective, saying it would focus on ensuring security, justice, and democratic prosperity through state power,” Na wetin Tinubu tok be dat.

You fit go read di tori see as Tinubu call for Military collaboration…READ MORE