Lagos chef dey under arrest for stealing from employers
Lagos State Police Command don arrest one chef wey dey identified as Wilfred Amoussou for stealing from his employers.
Di state Public Relations Officer, Benjamin Hundeyin, na hin tok this tori via series of tweet for hin handle on Thursday.
He yarn say Amoussou drug hin employers kon steal dia valuables, also, hin add say di victims na residents of Ikoyi, Banana Island, and Parkview area of di state.
FOR MORE NEWS: BREAKING: Supreme Court don adjourn new naira suit judgement
“Wilfred Amoussou go take up di job as cook/chef, he go kon drug hin employers with Benzodiazepines, and steal their valuables.
“He don do am to different victims, over years, for Ikoyi, Banana Island and Parkview.
“Some of hin past victims don come out to identify am.
“Shey you be victim? If yes, abeg, go Ikoyi Police Division for further necessary action,” THhis na wetin di police write for hin twitter post.
You fit go read di full tori about di chef wey dey under arrest for stealing from employers…READ MORE