fbpx
June 21, 2024

China hail Putin on im election win

china-hail-putin-on-im-election-win

China don hail Putin on top im election win wey dem announce on Monday. Dem yan say Putin collect 87.33 per cent of all di votes, according to official election data wey RIA state news agency provide.

Di foreign ministry spokesman, Lin Jian, yan say China congratulate Putin, and talk say China and Russia na big neighbors and partners for di new era. Dis na sake of dem dey enter strategic cooperation.

Putin wey don record victory wey no get competition, don praise Beijing, talk say dem go build and strengthen dia relationship. Putin say dem get di same goals for innovation for dia economies.

 

FOR MORE NEWS: Killing of soldiers: Ughelli King don break silence

 

China and Russia bin be socialist allies, but dem get better relationship now as dem dey see demselves as support against di West wey dey led by US. Dem dey celebrate 75 years of diplomatic relations dis year.

Putin believe say di common interests of both countries dey important and e go help dem solve international problems well-well.

You fit go read di tori as China hail Putin election…READ MORE