fbpx
September 29, 2024

Chrisland schools don release statement following di death of 12-year-old student

chrisland-don-release-statement-about-di-death-of-dia-student

Following di death of 12-year-old Whitney Adeniran, di management of Chrisland schools release statement on di death of one student.

Whitney Adeniran Chrisland schools release statement following death of 12-year-old student

This statement dey come after di mama of di late Whitney mom cry out for justice for social media, following report say her daughter fall down die during di school inter-house sports.

Also, di papa of di student, Michael Adeniran fon follow enter social media on Saturday night to demand investigation into di death of hin daughter. Hin call on di Lagos State government and di police make dem intervene for di matter.

Chrisland schools release statement following death of 12-year-old student

Meanwhile, di Lagos State Police Public Relations Officer, Benjamin Hundeyin, confirm di incident, hin tok say dem report di matter to di police immediately after di incident happen.

Presently, di case dey for di State Criminal Investigation Department and dem go do autopsy to know di circumstances wey lead to her death.

In response, Chrisland Schools release statement to address di death of Whitney Adeniran.

FOR MORE NEWS: “Gov. Godwin Emefiele na God sent to this nation” – Senator Ben Murray-Bruce

The statement read;

Di management and staff of Chrisland Schools Limited, for dia statement announce di death of dia precious student, Whitney Adeniran with deep sense of loss. Also, dem yarn say her painful exit happen on Thursday, February 9th, 2023.

Whitney na one of dia Day students wey bin no wan participate for di inter-house sports match past for reasons wey dem no dey very sure of.

However, on discretion, dem respect her decision because on di January 20, 2023, dem record when she complain about a not-too-buoyant health and immediately, dem contact her parents.

After di report that time,  Mr. Michael Adeniran, bin come carry her from school go house, and according to them,  dey emphasis to her parents to take critical look at her.

Chrisland also request say make di Adeniran family conduct thorough investigation to determine di cause of her death before her funeral.

You fit go read more of this tori…READ MORE