fbpx
December 22, 2024

Police arrest abductors of Ekiti APC Chairman

ekiti-police-arrest-three-suspects

Di Ekiti State Police Command on Thursday reveal say dem don arrest three suspects in connection with di abduction of di All Progressive Congress Chairman for di State, Hon Paul Omotosho.

Inside statement wey dey made available to newsmen for Ado-Ekiti, di Command Public Relations Officer, DSP Sunday Abutu reveal di tori on Thursday morning.

Hin reveal say di suspects don give useful information wey fit lead to di arrest of di prime suspects wey still plenty.

Also, inside di statement, dem inform di general public especially di good people of Ekiti State say di All Progressive Congress Chairman of di State, Mr Paul Omotosho alongside two others wey bin dey kidnapped by unknown hoodlums don regain dia freedom and dem don reunited with dia families.

 

FOR MORE NEWS: Enugu guber: Controversy trail LP inspection of BVAS machines

 

Di breakthrough bin dey possible through di combined efforts of di Police, other sister agencies, di local security outfits and di family members as well as di Ekiti State government.

In addition, di statement encourage Citizens make dem dey security conscious, vigilant and ensure di prompt reportage of any suspicious person or group of persons wey dem observe for dia locality to di  nearest Police Station or call 08062335577

You fit go read di tori see as Ekiti State Police arrest three suspects…READ MORE