fbpx
December 22, 2024

Presidential election: El-Rufai go betray you – Tinubu warned

El-Rufai-go-betray-Tinubu

Di All Progressives Congress, APC, presidential candidate, Bola Tinubu, don collect warn say hin beware of Governor Nasir El-Rufai, hin fit betray am..

Deji Adeyanju, one socio-political activist, warn Tinubu make hin dey prepared because El-Rufai fit betray am when time come.

Inside tweet, Adeyanju point out say di governor don betray President Muhammadu Buhari.

He stress am say di power na temporary.

FOR MORE NEWS: “I dey too loaded to be empty”- Billionaire E-Money share new photos to marks hin birthday

Adeyanju wrIte for inside twitter say El-Rufai go still betray Tinubu when di right time don set. Buhari dey learn new lessons. He nena even comot for Aso Rock and hin don already dey show hin kind of shege to expect. Power is always dey temporary.

El-Rufai, wey dey known to dey close to Buhari, bin speak against di president and hin government last week.

Also, di APC chieftain accuse Buhari say hin allowing evil pipo use am fight di APC.

El-Rufai yarn say those pipo wey dey use di president as instrument to defeat di APC dey do am because dem fail bid to force dia own candidate for di party during di June 2022 primaries.

Di governor bin dey react to Buhari pronouncement on Naira redesign policy and di ongoing currency crisis wey Nigerians dey experience.

He kon tok with confidence say di old naira notes go remain valid for Kaduna State.

You fit go read di full tori…READ MORE