fbpx
December 22, 2024

El-Rufai, and other governors no dey fight for vulnerable Nigerians – PDP chieftain, Ekwere

el-rufai-complain-aout-di-policy-on-vulnerable-nigerians-ekwere don-react

Mr Eric Ekwere, di Deputy National Director, Media, Atiku Support Organization, and member of di PDP/Atiku Presidential Campaign Council yarn say El-Rufai and other governors wey dey fight di naira redesign policy no dey fight for vulnerable Nigerians.

Governor Nasir El-rufai directive on di old N500 and N1000 notes to remain legal tender for Kaduna State despite President Muhammadu Buhari order don stir reactions from Nigerians.

Buhari for inside televised address on Thursday bin direct Central Bank of Nigeria (CBN) make dem extend di validity of old N200 notes till April 10.

Also, hin instruct say pipo still fit carry di existing old N1,000 and N500 notes go deposit for di CBN for di next 60 days.

However, Governor El-rufai wey challenge di policy for court, give order say di old N500 and N1000 notes go remain valid for Kaduna State pending di Supreme Court’s decision.

FOR MORE NEWS: 2023 poll: APC El-Rufai, Ganduje, Badaru group dey against Buhari

According to Ekwere, e yarn say El-rufai no dey act like leader, also hin yarn say APC dey in confusion since 2015.

Ekwere yarn say EL-rufai dey complain about di policy wey dey affect di vulnerable Nigerians despite di 200 naira wey CBN don release to di advantage of di vulnerable people. These people no dey transact N1000 in bulk and you still dey complain. Hin point be say he no understand why El-rufai dey complain.

That one mean say something dey hidden somewhere wey you n wan tell di public. You dey put di public against di government. If di pipo for di state continue to transact with di already expired denomination, shey no be risk you dey expose di pipo to?  All these things na wetin Ekwere yarn.

Ekwere dey wonder why members of di ruling party start to blaming di PDP presidential candidate for di policies of dia own government. In addition, hin advise dem say make dem carry dia cross leave di PDP out of dia crisis.

You fit go see di full tori…READ MORE