“Govt. must look into fake churches” — Pastor don stir concerns with hin style of miracle
Nigerians don call for government to look into di matter of fake churches as a preacher identified as Pastor Amos Isiah perform miracle wey dem feel say na fake.
Di video wey dey making rounds on top social media capture as di preacher dey jump throw kick. Hin throw di kicks for di direction di man wey come for miracle and deliverance for hin church.
As di matter be, di pastor style to deliver hin congregants don spark concerns by plenty pipo wey feel say di ministry dey deceive pipo.
FOR MORE NEWS: Why I wan be President of Nigeria – Tinubu letter to Nigerians[Full text]
However, because of di pastor style of miracle, social media users, advise say at some point for Nigeria, churches wey pipo feel say na fake must dey investigated by di Federal government of Nigeria.
Below na reactions wey follow Pastor Amos Isiah miracle session
omega_iyke101 write, “Time don reach make federal government begin look into all these , seriously. Di Westerners dey see us as joke . Kudos to Rwanda 🇷🇼 president, he close plenty fake churches ⛪️ and mosques 🕌. As a result of deceit. Make we do better for this country.”
sylvalinks write, “Mumu ppl no dey ur house d pray 🤲 continue roaming around from one church to another ndi ara.”
travis_joelson add hin own, “no dey too quick to judge if you no understand mysteries.”
precious.emma5 write, “Person wen dey under anointing dey laugh 😹
You fit go read di full tori…READ MORE