fbpx
December 22, 2024

Biafra: Buhari govt explain why dem bring Nnamdi Kanu back from Kenya

fg-don-explain-why-dem-arrest-Nnamdi-kanu

Di President Muhammadu Buhari-led Federal Government FG don explain why dem arrest di leader of di Indigenous People of Biafra, IPOB, Nnamdi Kanu, for Kenya, and why dem carry am come Nigeria.

Dem explain say Kanu bin dey subjected to extraordinary rendition from Kenya so dat hin go continue hin ongoing trial for Nigeria.

Also, dis explanation bin dey contained inside di Federal Government amended notice of appeal before di Supreme Court marked: SC/CR/1361/2022.

 

FOR MORE NEWS: Buhari suspension of fuel subsidy removal no dey surprising – Former TUC president, Esele

 

Di appeal dey against di October 13, 2022 judgment of di Court of Appeal for Abuja.

Also, di Federal Government accuse di Appeal Court of failing to consider the illegality of Kanu jumping bail and hin refusal to make himself available for trial, wey make hin return to Nigeria necessary.

Meanwhile, di Supreme Court okay di Federal Government to file nine grounds of appeal.

A five-man panel of di apex court led by Justice John Okoro grant di Federal Government permission for di appeal.

You fit go read di tori as FG explain why dem arrest Kanu…READ MORE