fbpx
December 22, 2024

Election 2023: Google dey celebrate Nigeria

google-celebrate-nigeria

Google, wey be di world largest search engine dey celebrate Nigeria on dia website with special doodle as di country dey conducts di general election on Saturday.

Di doodle features di Nigerian green-white-green colour, with a picture of election ballot box display.

If person click on di doodle, e go open up another page of di Independent National Electoral Commission (INEC) website – timetable for di 2023 general election and 2023 general election updates show for there.

Also, when person place cursor on di doodle, e go read: “Nigeria National Elections 2023.”

Di Google doodle na to mark di special day as Nigerians decide dia next leader wey go take over from President Muhammadu Buhari.

FOR MORE NEWS: Labour Party dey vex as INEC omit di party logo on Lagos ballot papers

As well, google dey use doodle like that to celebrate numerous historical figures and events around di world, just like dem dey celebrate Nigeria today..

Meanwhile, On Thursday, INEC Chairman, Prof Mahmood Yakubu, announce say 87.2 million Nigerians don collect dia Permanent Voters Cards, PVCs.

Yakubu yarn say  current voter register get over 93.4 million voters, and dem add say INEC go continue to clean it up with technology going forward.

He mention say 93.3 per cent collect dia PVCs, while 6,259,229 cards — 6.7 per cent of PVCs still dey uncollected.

You fit go read di full tori…READ MORE