fbpx
September 29, 2024

Lagos government don shut down Chrisland school over Whitney Adeniran death

government-don-shut-down-chrisland-adeniran-death

Di Lagos State government don order di closure of Chrisland School for Opebi, Ikeja, after di death of di student, Whitney Adeniran.

Commissioner for Education, Folasade Adefisayo on Sunday yarn say di school go  remain closed pending di outcome of full inquiry.

Also, di official sympathize with di family and friends of di deceased and dem pray say make her soul rest in peace.

However, Adefisayo, call for calm, hin give assurance say dem no go  spare any effort in investigating the incident.

Di father of di late 12-year-old call for investigation into her death for statement wey don circulate on social media.

Michael Adeniran yarn say she bin no get any health condition, and she no dey sick when the school bus picked her up for inter-house sports activities last Thursday.

While di parents don insist say di student bin dey hale and hearty before she comot for house on di said day, di school management don deny any wrongdoing, dem yarn say dia officials take appropriate steps to save di deceased when she “fall down” for di stadium.

However, di update be say Lagos government don shut down Chrisland school over Whitney Adeniran death.

You fit go read di full tori…READ MORE