fbpx
December 23, 2024

“Na Coward you be, you don expose yourself “– Pipo dey criticize Governor Wike as hin fail to name hin preferred candidate

governor-wike-neva-announce-preferred-candidate-publicly-

Pipo don describe Governor Nyesom Wike of Rivers State as coward because hin fail to make to make real hin threat of publicly announcing hin preferred candidate for di 2023 presidential election and hin neva join campaign nationwide for di candidate.

Late last year, Governor Wike bin tell people of Rivers say by January, hin go make public know hin preferred of presidential candidate, and hin vow to move from State to State to campaign for di candidate.

But January don passed and di Governor neva make hin choice public.

E neva too tey wey some of hin aides enter social media, share di photo of di presidential candidate of di All Progressives Congress, APC, Bola Tinubu with di caption ‘Is about time.’

But for inside recent interview, Wike yarn say he neva tell  public di method wey hin go use announce hin preferred presidential candidate.

FOR MORE NEWS: PDP Crisis: Wike Don Finally Drops When His Hammer Go Land on Ayu and Other Party Leaders Head

Wike na one of di five PDP governors wey dey known as di Integrity Group or G5, and dem still stand on dia decision say dem no go allow di North producing both di party national chairman and presidential candidate.

Di group yarn say there must be equity, fairness, and justice, because of this matter, dem no gree join Atiku campaign for dia States.

Former Director-General of Nigerian Maritime Administration and Safety Agency, NIMASA, Dakuku Peterside,  on Tuesday, bin don challenge di  Rivers governor to name hin candidate.

And in response, Wike fire APC chieftain back, hin yarn ssy hin bin no promise to make his declaration in front of camera. Wike still yarn say hin no give one particular date for January for when he go make hin declaration.

And as Nigerians dey wait for di decision of di Governor and hin colleagues, one chieftain of di APC, Chief Eze Chukwuemeka Eze don describe di Governor as coward and man wey dey confused.

For another similar view, one  former Nigerian lawmaker and social critic, Senator Shehu Sani, yarn say  Wike-G5 governors dey play hard to get.

you fit go read di full tori…READ MORE