fbpx
December 22, 2024

Grant us access to BVAS before reconfiguration or…, LP don tell INEC

grant-us-access-to-bvas-lp-to-inec

Di Labour Party of Nigeria don issue a 3-day Ultimatum to di Independent National Electoral Commission, INEC make dem allow di Party lawyers and her agents inspect di Bimodal Voter Authentication System BVAS machines, alongside other electoral materials or face di Obidient movement.

Chief spokesman, of di Labour Party Presidential Campaign Council (LPPCC), Tanko Yunusa tok dis one on Saturday during telephone interview.

According to am, di Independent National Electoral Commission don chose which court order dem go obey and which one dem go disobey.

Hin tok say di thing wey INEC dey do na clear and fragrant disobedience to di court order wey empower LP to inspect BVAS. 

Also, he yarn say di commission don start di configuring of BVAS machines after Court don say make dem allow di Labour Party inspect di BVAS.

FOR MORE NEWS: Presidential election: INEC chairman threatens lawsuit after PDP’s rigging allegation

He yarn say dat action go tamper with di already stored and controversial result of di Presidential Election. Dis na machine wey Labour Party don tok say dem wan inspect before configuration.

Na wetin hin tok be dis: “They have begun configuring the BVAS machines. They denied us, and have not allowed us to have access to the BVAS Machines at all, these are the issues.

As di matter be now,  dem don tok say if INEC no allow dem, dem go dey forced to call all dia pipo, and dem go mobilize dia self go INEC office to demand for di rights of di pipo based on di last election.

You fit go read di full tori…READ MORE