fbpx
September 29, 2024

INEC don appeal Osun poll judgement, dem dey defend Adeleke victory

inec-appeal-judgement

Di Independent National Electoral Commission INEC don appeal di judgement of di Election Petition Tribunal.  That tribunal nullify di victory of Osun State Governor, Senator Ademola Adeleke, for di July 16 governorship poll.

Di date of di Notice of Appeal na January 30, 2023. Also dem file am before di Court of Appeal on Wednesday. Di court dey for Akure Division, for Osogbo.

For inside di Notice of Appeal, di commission list 44 grounds of appeal. In addition, hin ask di court make dem set aside di judgement of di tribunal.

INEC also suggest to di appellate court say make dem declare say di petition wey All Progressives Congress and dia candidate file for di poll, Adegboyega Oyetola lack merit.

FOR MORE NEWS: APC dey accuse Adeleke say hin sponsor protests, PDP don react

Di tribunal wey bin dey led by Justice Tertsea Kume bin nullify Adeleke victory and announce Oyetola as di duly elected governor of di poll fo di judgement of January 27, 2023.

Also, di panel bin yarn say dem see over-voting for 744 polling units and that one make dem remove excess votes from di votes wey dem collect for Adeleke and Oyetola.

Inside di Notice of Appeal wey dey signed by di counsel, Prof. Paul Ananaba (SAN) and 17 other lawyers, di commission yarn say di tribunal make mistake for di law. This na as dem claim say Adeleke no score majority of di lawful votes.

You fit go read di full tori about INEC appeal to di judgement of di Election Petition Tribunal…READ MORE