fbpx
September 29, 2024

“We don settle fuel and cash scarcity wahala, 2023 elections go hold as planned” – INEC

inec-say-elections-go-hold

Chairman of di Independent National Electoral Commission, INEC, Mahmood Yakubu don give Nigerians assurance say di forthcoming elections go hold regardless of fuel and cash scarcity issues.

Mahmood Yakubu drop this update after meeting with di Federal Executive Council (FEC) wey President Muhammadu Buhari head on Wednesday, 8th of February.

Hin revelation trails di plenty protests wey dey rock different parts of di country over di scarcity of fuel and cash hoarding of new Naira notes.

Yakubu yarn say dem hold meeting with di National Union of Road Transport Workers and dem raise that matter as an issue of concern. According to wetin hin tok, di first one na di availability of petroleum products.

FOR MORE NEWS: 2023 elections: “Think carefully” – Akinyemi dey tell Nigerians

Also, Immediately after that meeting, dem connect di matter with di leadership of di Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPC) and right now some technical community dey work on di matter.

Di idea na for them to help with dia over 900 land mega stations as well as floating mega stations nationwide for di purpose of stocking products to make sure say di commission no suffer any hindrances for di movement of personnel and materials for di elections.

Another issue wey be di second one na di currency issue. Again, dem get engagement yesterday with di Governor of di Central Bank of Nigeria. And hin don assure dem say di commission no go suffer any hindrances on that score. Also, in add say all dia accounts, national and state dey with di apex bank.

In conclusion, as dem raise those challenges, dem don find solution to dem. So, INEC yarn say make everybody dey rest assured say di elections go hold as scheduled on di 25th of February for di national and on di 11th of March for di state’s elections.”

You fit go read di full tori…READ MORE