fbpx
December 22, 2024

“I dey suffer over Naira scarcity; My family no fit cook – Orji Uzor Kalu

kalu-suffer-naira-scarcity

Former Governor of Abia state, Orji Uzor Kalu don open up say him and hin family day suffer over di Naira redesign, scarcity and cashless policy.

Orji Uzor Kalu

On Monday, February 20, Orji Uzor Kalu claim say hin family no fit cook again because of di policy, this na as hin dey tok on top  Channels TV.

He yarn say di policy dey right but hin no dey keep money for hin house. On top di matter hin tok say hin dey suffering.

Also, e get one tori wey Kalu tok, he yarn say him and hin house manager tell hin wife for Abuja say dem no get money to cook food, dem dey suffer because of Naira scarcity.

Hin wife bin dey roam around and dem dey feed over 250 people every day. Na problem to hin and to everybody.”

Also, as reaction to President Muhammadu Buhari directive for di Central Bank of Nigeria to make 200 Naira notes circulate until di eve of di March 11 governorship election, Na wetin Orji Uzor Kalu yarn be this;

“This na why if I dey for di position of Mr President as I don tell you before, I go listen to di Supreme Court judgement. Also, di Supreme Court to me, whether dem dey right or wrong, Mr President suppose obey the law and ask hin Attorney General to put a review to the Supreme Court.

You fit go see di full tori…READ MORE