fbpx
December 22, 2024

APC wan do direct governorship Primary for Kogi State today.

kogi-apc-to-elect-flagbearer

Di Kogi State All Progressives Congress, APC, members today, Friday, go file out to elect di party governorship flagbearer through direct primary.

Address di members of di party for stakeholders’ meeting yesterday, di Chairman Congress Committee and Governor of Zamfara State, Alhaji Bello Matawalle yarn say only up-to-date financial members wey dia names dey register na hin go dey allowed to vote.

Di ones wey go slug am out for di primary election na Barr. Salami Ozigi Deedat, Hon. Usman Ododo, Dr. Sanusi Ohiare, Sen. Smart Adeyemi and Prof. Stephen Ocheni. Na dem be di major contenders.

FOR MORE NEWS: Tinubu dey rest for Europe ahead of May 29 inauguration – APC

Remember say di Kogi State Deputy Governor, Chief Edward Onoja on Thursday bin withdraw from di Kogi State Governorship race.

Also, di former Accountant General, Jibrin Momoh, and Asiru Idris, former Commissioner For Finance, Budget and Economic Planning follow withdraw from di race.

Banji jimoh, Muhammad Jamiu Asuku, Friday Idachaba and Hajia Halima Alfa don withdraw from di race too.

Di Chief Returning Officer for di APC Governorship Primary, Gov. Bello Matawalle of Zamfara State na hin announce dia withdrawal.

You fit go read di tori as Kogi APC file out to elect flagbearer…READ MORE