fbpx
September 29, 2024

2023: Di man wey meet Tinubu no be our Kano guber candidate – Labour Party

labour-party-kano-candidate

Di Labour Party don deny report wey yarn say di presidential candidate of di ruling All Progressives Congress, APC, Bola Tinubu recently meet with di gubernatorial candidate of dia party for Kano State.

According to some reports wey come out on Monday say Tinubu meet with di governorship candidate of di party for Kano, Bashir Ishaq to take style deceive am make e join di ruling party.

But di Chief Spokesperson of di Labour Party Presidential Campaign Council, Dr Aliyi Tanko address di report on Tuesday. Hin yarn say  Bashir Ishaq no be recognized candidate of dia party.

According to am, di party chairman for di State, Mallam Mohammedstill be di authentic candidate name wey dem submit give di Independent National Electoral Commission, INEC.

Although Tanko reveal say Ishaq bin struggled to emerge as flagbearer of di party, but he no dey recognized.

He yarn say that particular man wey meet with Tinubu neva dey recognized by di INEC. Also, hin no dey recognised as a Labour Party Kano candidate.

Di candidate of di party na Mallam Mohammed, di LP Chairman.

You fit go read di full tori…READ MORE