fbpx
December 22, 2024

Kaduna Labour Party don suspend three members

Labour-party-suspend-three-members

Di Labour Party, Kaduna State chapter, don suspend three of di card-carrying members wey take part for wetin dem call di  “so-called NEC meeting” wey happen for Bauchi, Bauchi State on Wednesday, May 3, 2023.

Among those suspended na Bashir Idris Aliyu, Alhaji Ibrahim Sidi Bamali and Engr Michael Ayuba Auta. And, di decision of dia suspension go dey forwarded to di National Working Committee of di Labour Party and other relevant bodies for further actions.

 

FOR MORE NEWS: Wike knocked dey under fire for naming new Rivers courthouse after hin wife

 

Addressing newsmen for Kaduna on Saturday, Idris Yusuf, di party state Public Relations Officer explain say di party
comot diasef from di illegal and counterfeit group of di party led by one Lamidi Apapa.

He call on di members and di general public say make dem disregard any body or group wey parade themselves as state officials of di party for Kaduna outside di recognized state exco led by Hon Auwal Tafoki.

Also, hin yarn say di Kaduna State Labour Party go makesure say di party remains united and become di most tough political platform for di state and for Nigeria.

You fit go read di tori as Labour Party suspend three members…READ MORE