fbpx
September 29, 2024

“No cash, No problem” – Nigerian lady dey dance with account number for her hand during wedding

lady-dance-with-account-number-during-wedding

Viral video of beautiful Nigerian lady don stir reactions online. Di lady dey dance with paper wey hold bold inscription of her account number during di wedding wey she hold recently.

Amid di scarcity of naira notes for di country,  during di wedding, dem create way to receive monetary gifts from guests. Although pipo mistake di lady wey wear pink gown for di bride.

FOR MORE NEWS: “I don date Yahoo Boy and hin neva give me shi shi” – Phyna don reveal

For di viral clip, di lady hold wide, rectangular piece of paper with her account number. As she dey dance, she hold di  paper.

E dey obvious say pipo wey no get cash to spray for di wedding due to scarcity go just make transfer to her account.

Also, di celebrant don make pipo dey tok online about di strategy wey dem create for guests to spray money for her party.

As dem try continue di culture of spraying money alive amid di lingering naira scarcity for Nigeria, di host on go extra mile to ensure say her guests spray money.

She print customized ‘naira notes’ with her picture for di notes and she sell them to her party guests for a fee.

Di video wey dey make rounds online shows di guests as dem dey spray money happily on di performer and celebrant during di event.

You fit go read di full tori…READ MORE