fbpx
December 22, 2024

“Your enemy dey closer than you fit imagine” – South African lady narrate as female friend steal her man

lady-narrate-how-her-friend-steal-her-man

One South African lady wey dey identified as @munira_mudi don narrate  how her friend ‘snatch her man from her.

She reveal say she and her man bin invite her friend for lunch on di 15th of September 2020, and that time na di first time wey dem met each other.

 

E never too tey after that time, dem start to dating without her knowledge. Her friend even surprised her on her baby shower as she fly all the way from Capetown to attend.

 

FOR MORE NEWS: “I no fit argue with you if you no get property” – BNXN don tok following fight with influencer

She share pictures of herself, her friend and her man, Na di caption wey she use be this:

“15th September, 2020, The day after I introduced my “Friend” to my baby daddy (FYI they were in a relationship)

“She went to lunch with us and even took pictures of us, she won’t stop chanting “MY FAV COUPLE”

On top di matter, she yarn say di saddest thing about betrayal be say e no dey ever come from your enemies. E dey always come from friends and loved ones. Better to get enemy wey go slaps you for face than  fnend wey go stabs vou for back.

According to di lady, this friend wey steal her man na friend wey dey always want wetin her friends get. And no be di first time wey she go do this kain thing. Hoever, e go definitely be the last.

To conclude di tori, she yarn say she dey in good space, she just wan put di tori out so that pipo go know say dia friend fit worse pass enemy, 

You fit go see di full gist…READ MORE