fbpx
December 23, 2024

Lagos fire: Buhari express sadness as he mourn death of security guard

lagos-fire-buhari-express-sadness

President Muhammadu Buhari don express sadness over di Lagos fire incident wey destroy di Akere Spare Parts Market for Kirikiri Road, Akere Bus Stop, Olodi-Apapa for Ajegunle on Wednesday morning.

Also, President Buhari express deep sadness over di death of one  65-year-old security guard and di loss of properties and means of livelihood of some Nigerians for di fire wey happen for Akere Spare Parts market, Lagos.

Buhari sympathize with di traders and dia families wey dis sad and unfortunate incident happen to.

FOR MORE NEWS: March 11 polls: Confusion dey everywhere as INEC postpone state elections

Another thing wey dey worry President Buhari na di fact say dat same fire incident happen for di popular Balogun market some weeks ago. And hin call on relevant authorities say make dem take precautions to stop wetin dey cause di fire so dat e no go happen again.

Dis matter bin dey announced inside statement by di Senior Special Assistant to di President on Media and Publicity, Garba Shehu.

However, Buhari commend di Lagos State Fire Service as dem respond to di incident, and dem rescue di nearby filling station wey get 33,000 litres PMS tanker, amongst other buildings.

You fit go read di full tori…READ MORE