fbpx
December 23, 2024

Five years mandatory practice: Medical doctors draw battle line

medical-doctors-greener-pastures

Nigeria House of Representatives dey inside news following di bill wey seek to stop medical doctors from seeking greener pastures less than 5 years after medical school.

Di action of di parliament come as a reaction to di exodus of medical doctors within the last few years.

Brain drain don become serious challenge for di Nigeria health sector, and di nation dey lose healthcare workers wey dey fly go other countries.

Dis coming crisis don overwhelm government authorities, with no plan to tackle dem.

FOR MORE NEWS: Arewa Elders Caution Obi, Datti-Ahmed Against Provocative Utterances

According to di World Health Organisation, WHO, Nigeria dey suffers from insufficient doctors and di Kontri doctor-patient ratio over five times dey lower than di organisation recommendation.

Also, report tok say di kontrri dey lose hundreds of doctors annually to brain drain, plenty of dem dey go di United Kingdom (UK).

Health officials yarn say at least 5,600 Nigerian medical doctors don migrate to di United Kingdom (UK) alone inside di last eight years.

In August 2022, di Nigerian Medical Association (NMA) yarn say a total collapse of di health sector dey come if urgent steps no dey taken to address di brain drain for di sector.

You fit go read di tori on di matter of medical doctors and greener pastures…READ MORE