fbpx
December 22, 2024

“Wetin happen for Lagos na war, no be election – LP Gbadebo Rhodes-Vivour

na-war-happen-for-lagos

Di 2023 Labour Party candidate for di just concluded gubernatorial election for Lagos State Gbadebo Rhodes-Vivour, don insist say wetin happen for di state na war, no be poll.

Speaking on top Arise Television morning show on Friday, Rhodes-Vivour yarn say di responsibility of di Independent National Electoral Commission (INEC) must improve amid the election conduction.

According to Rhodes-Vivour hin say, “Wetin happen for Lagos na war on Lagosians no matter how dey want colour am or module di waters.

FOR MORE NEWS: Group don demand arrest of interim government agitators

Di INEC in March bin declare Governor Babajide Sanwo-Olu of di All Progressives Congress, APC, as di winner of di Lagos gubernatorial election.

Sanwo-Olu score a total of 762,134 to defeat di first runner-up, di Labour Party Rhodes-Vivour, wey poll 312,329 votes, while Abdulazeez Adeniran of di Peoples Democratic Party, PDP, get 62,449 votes.

You fit go read di tori…READ MORE