fbpx
December 22, 2024

NITDA dismiss Tinubu N50,000 grant scheme

nitda-dismiss-Tinubu-grant-scheme

Di National Information Technology Development Agency NITDA don dismiss viral grant scheme wey don circulate on top social media as ‘President Bola Tinubu N50,000 Cash Grant’ to Nigerians.

Dis tori dey contained inside statement on Wednesday for Abuja by Mrs Hadiza Umar, Head, Corporate Affairs and External Relations, NITDA.

Umar, wey caution Nigerians about di scheme, yarn say di website wey dey associated with di grant na phishing website wey dey designed to mislead unsuspecting citizens.

 

FOR MORE NEWS: Gov Mohammed don approve recruitment of 1,684 workers

 

According to her, NITDA-Computer Emergency Readiness and Response Team (NITDA-CERRT) hereby wish to advise di public make dem no click on unknown links.

She explain say di government go always communicate dat kain information via di appropriate agency wey dey supervise dat kain programmes if any one dey.

Also, Umar advise di public make dem contact the agency CERRT on email via cerrt@nitda.gov. ng, phone number- +234 817 877 4580, web address- www.cerrt.ng.

You fit go read di tori as NITDA dismiss viral grant scheme…READ MORE