fbpx
December 22, 2024

Japa: ‘You go discourage students from reading Medicine’ – NMA oppose five-year compulsory practice

NMA-don-oppose-di-five-year-compulsory-service

Di Nigerian Medical Association NMA don oppose di proposed five-year compulsory service for medical and dental practitioners.

 

Last Thursday April 6, a bill seek a minimum of five years for doctors to practice for di country, before den collect full licence to second read for di House of Representatives.

Honourable Ganiyu Johnson (APC/Lagos) wey sponsor di bill yarn say dem wan amend di Medical and Dental Practitioners Act 2004, to address di brain drain for di Nigerian health sector. Dis na because of hin concerns about di mass exodus of healthcare workers wey dey comot for Nigeria for greener pastures abroad

If di bill dey passed into law, e go mandate medical and dental practitioners wey dey train for di country to practice for at least five years before dem collect full licence.

 

FOR MORE NEWS: “28 people kpai during 2023 elections but 800 for 2011” – Tinubu

 

Speaking on Wednesday April 12, di NMA President, Dr Ojinma Uche, yarn say di bill no be di solution to di pending crisis for Nigeria healthcare system.

“That is not the solution.” Na wetin hin tell Channels Television Politics Today.

Also, hin tok say di bill go discourage young medical students from reading Medicine. And hin tok say hin own fear be say di news fit make plenty doctors start to travel comot dis year before di bill enter law.

“If you now decide that Nigerian doctors cannot have full or permanent licence for five years after graduation, automatically, you have made them house officers for five years.” Na wetin hin tok be dat.

You fit go read di tori as NMA oppose di five-year compulsory service…READ MORE