fbpx
September 29, 2024

Provide evidence I go quit presidential race – Obi don open up on allege N2bn bribe to CAN

elections-saturday-nigeria-obi

Di presidential flagbearer of di Labour Party, Peter Obi don deny di claim by one pastor wey allege say hin bribe some members of di Christian Association of Nigeria, CAN, with N2bn to gain dia support.

Remember say some reports of di allege bribe to CAN bin flood social media space on Sunday, and some stakeholders of di ruling All Progressives Congress, APC, bin dey mock Obi.

Spokesperson of the Tinubu Shettima campaign council, Festus Keyamo and other APC stalwarts tweeted the allegation on Sunday.

This development follow an allege petition wey one Pastor Frank Onwumere write to address di CAN President. Hin question am say why dem for share di allege N2bn for some churches, while others dey excluded.

FOR MORE NEWS: “Hin Story Don Change” Cubana Chief Priest Don Vow To Make Di Teenager Millionaire As Hin Stand In Front Of Peter Obi Convoy

Reacting, di CAN National President, Archbishop Daniel Okoh for hin quick statement on Sunday, yarn say di organization no receive any money from di presidential candidate.

He don vow to find di source of di petition and take proper action.

Speaking on di matter, di former Anambra governor, for interview with Channels TV on Monday, yarn say hin no even get N2bn to give anybody.

He challenge di pipo wey raise di allegations say make dem bring evidence. Hin even tok say he dey ready to quit di race if di allegation dey proven to be true.

Peter Obi yarn say hin believe say di clergymen follow get problem. Also, dia followers dey suffer, so they want good governance.

Hin still ask say why hin for give dem money sef? Peter Obi yarn say na them suppose give am money make he use support  hin campaigns.

In conclusion, hin tok say hin fit comfortably tell anybody say hin never give one Naira to CAN.  And if anybody fit prove say hin give one Naira to CAN, hin go stop di race.

You fit go read di full tori…READ MORE