fbpx
December 22, 2024

Peter Obi deny say hin call 2023 presidential election ‘religious war’

obi-deny-di-religious-war-matter

Di presidential candidate of di Labour Party (LP), Peter Obi, don deny di claim wey yarn say hin call di just concluded presidential election a “religious war.”

Remember say Peter Obi inside leak audio clip, bin dey encourage founder of Winners Chapel, Bishop David Oyedepo say make hin encourage Christians for South-West and Kwara state to vote for am, hin kon stress say di presidential election na “religious war.”

But for recent interview with Arise TV, di former Anambra State governor deny say hin call di presidential election “religious war.”

 

FOR MORE NEWS: “Dis one risky, remember your pikin”, Tonto Dike 3rd liposuction don trigger reactions

 

He maintain say di clip na di handiwork of “manipulators.”

Also, hin yarn say hin no be ethnic/religious bigot,  and hin yarn say hin dey sponsors plenty Muslim residents for  Onitsha on pilgrimages to Mecca.

Also, hin tok say make pipo no forget say na only one person tell hin supporters make dem ‘snatch am! Grab am! and run with am’ during dis election season.”

You fit go read di tori as Obi deny di tok about di religious war matter…READ MORE