fbpx
September 29, 2024

Obi dey lead new poll, Tinubu fit get silent voters

obi-lead-new-poll-but-tinubu-fit-get-silent-voters

Di new poll by Stears Nigeria don show say di candidate of di Labour Party, Peter Obi dey 41% lead ahead of di February 25 election.

Bola Tinubu of di All Progressives Congress (APC) and Abubakar Atiku of di Peoples Democratic Party dey follow closely at 31% and 20%, respectively.

However, 36% of di respondents still remain silent when di question of who dem go vote for come.

Stears, for new poll wey dem release on Tuesday, mention say di “poll covers 6,220 respondents across Nigeria 36 States, and e make am di largest telephone-based electoral poll for Nigeria.”

However, di model wey di Stears use, also show say Tinubu go win di election for di event of low turnout of voters, But na obi dey lead di new poll.

Di former Lagos State governor go get 39% of di votes, while Obi and Atiku go get 32% and 22% of di votes respectively.

According to di pollsters, “Stears prediction model believe say Tinubu get di most silent voters i.e. people wey get am for mind to vote for Tinubu but neva wan announce am during an interview.

As di elections dey near, everybody dey prepare to go vote who dem want. However, di major thing wey dey pipo mind, na to vote for person wey go lead Nigeria well.

You fit go read di full tori…READ MORE