fbpx
December 22, 2024

Obi represents new path for Nigerians – Atedo Peterside

obi-represents-new-path

One great economist and founder of Anap Foundation,  Atedo Peterside, don endorse di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi, for Saturday election. He yarn say  Obi represents a new path for Nigerians.

Di founder of Stanbic IBTC Bank Plc announce this level as hin dey tok on top Arise TV programme wey dey tagged, ‘The 2023 Presidential Election in view’ on Thursday.

Also, as hin dey explain di reasons why he go vote for LP Obi, Peterside said, “yarn say Obi represents new path. And hin like di fact say di new path no get majority for di National Assembly because e go stop di executives from bringing ‘nonsense on economic fronts’ to di parliament.

FOR MORE NEWS: Nyesom Wike dey plan to comot for Nigeria – Eze don reply PDP on Amaechi-Atiku link

According to am, hin like arrangement where nobody dey control di parliament. If person bring project for deliberation,e go dey approved only if e dey based on national interest. So, na new thing,” hin stress this tok.

Also, as hin dey answer questions on di personality and experience of di LP presidential candidate, di foremost economist yarn say hin no agree with pipo wey conclude say Obi no get federal experience because hin serve on di Economic Management team of former President Goodluck Jonathan for four years with Obi when he hin be di Anambra State governor.

You fit go see di full tori…READ MORE