fbpx
December 22, 2024

Nigerian man don kpai for police custody wey dey South Africa

olawunmi-kpai-inside-police-custody

One Nigerian man, Abiodun Victor Olawunmi, don kpai according to report inside di custody of di South African Police Service for Johannesburg.

At di time of filing this report, specific details wey surround di incident remain unclear. However, Edward Sunday, one Nigerian wey dey live for Sandton, Gauteng, from Oyo State, claim say Olawunmi suffocate.

“Nigerian suffocated by South African Police”,Na wetin Edward write on top Facebook be dat.

Hin claim say di police arrest di deceased on Saturday, July 15, 2023, during raid wey dey conducted by Minister of Police Bheki Cele for Johannesburg Central and di surrounding areas.

 

FOR MORE NEWS: “Na Difficult Journey”- Davido Adopted Son Don Graduate From University

 

Upon learning about Abiodun’s arrest, hin brothers immediately start to prepare to visit am for di police station. Unfortunately, dem receive devastating call from officer wey inform dem of Abiodun tragic demise.

When the brothers reach di Johannesburg Central Police Station, dem meet heart-wrenching sight of Abiodun’s lifeless body for di parking lot.

Meanwhile, photos wey dey posted by one Nigerians for South Africa page on Facebook, show Nigerian nationals wey dey protest over di death of Olawunmi.

You fit go read di tori see as Nigerian man Olawunmi kpai inside police custody…READ MORE