fbpx
December 22, 2024

Ontop good governance mata we bi one, Tinubu tell labour leaders

image-285

Presidential candidate di ruling party of di All Progressives Congress, APC, Asiwaju Bola Tinubu don assure di organised labour leader say make dem no worry say dem dey together in advocating good governance.

Tinubu tok say, democracy no dey easy to manage, hin tok say e dey competitive, insults, abuse, frustrations na hin full am. but yet democracy na di best form of governance.

U FIT ALSO READ Obi be like Morocco, hin go lose steam – Bwala

APC presidential flag bearer tell Labour leaders say na hin be di most qualified candidate among di other presidential candidates to lead Nigerians to di promise land.

Di meeting na one of di engagement wey di APC presidential flag bearer don get with different group of pipol to lobby for votes ahead of di February 2023 presidential election.

Di leaders of di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC), Ayuba Wabba and Festus Osifo bin dey for dat meeting too.

Other pipol wey show face for di meeting include vice presidential candidate Senator Kashim Shettima, Speaker of the House of Representatives, Femi Gbajabiamila, Governors Simon Lalong (Plateau), Atiku Bagudu (Kebbi), Abubakar Badaru (Jigawa) and Abdulrahman Abdulrasaq (Kwara).

Tinubu tok say, “ hin don spend hin entire political life dey advocate for di right and interest of ordinary Nigerians.

Tinubu tok say hin “ hin hope say dem go continue to bi friends and brothers.  as di countri don experience many trials, battles, independence, wars, but so far so good  dem conquer all of dem.

To read di full tori CLICKHERE