fbpx
December 22, 2024

Election result: One of una dey lie – Oshiomhole to Atiku, Obi

oshiomhole-to-atiku-obi

A former Governor of Edo State, Adams Oshiomhole yarn say either Atiku Abubakar or Peter Obi dey lie for claiming victory for di last Saturday presidential election.

Candidates of di Peoples Democratic Party, PDP, and that of di Labour Party, LP, address di press separately for di first time on Thursday after di announcement of di election result by di Independent National Electoral Commission, INEC, on Wednesday.

INEC declare on Wednesday say Bola Ahmed Tinubu of di APC na hin be di winner of the Saturday, 25th February, 2023, presidential election.

During dia separate briefings, di two politicians vow say de go carry di matter go court to challenge di victory of Bola Tinubu and di APC. Dem insist say APC thief dia mandates.

FOR MORE NEWS: 50mw electricity plant commissioning by Buhari don Maiduguri residents happy

Obi tell di press clearly say na him win di presidential election for one earlier press conference and Atiku make di victory claim later on Wednesday evening.

But a former Chairman of di Nigerian Labour Congress, NLC don chok mouth. Also, na hin win di Edo North senatorial election on Saturday. Oshiomhole , yarn say di Atiku and Obi dey accuse themselves of rigging each other out.

“Between His Excellency Peter Obi, my very good friend and His Excellency Atiku Abubakar, one of dem fit dey lie,” Oshiomhole tell Channels TV.

“So, between di two of them, they fit dey try to rig each other out, so one of them fit dey lie and when they go to court, I dey sure say na one thing wey pipo go see dis na as two pipo dey claim victory.

“So, dem dey indirectly accuse one another of rigging each other out even for the second position,” Na wetin hin add be that.

You fit go read di full tori…READ MORE