fbpx
September 29, 2024

Osun APC dey demand immediate transfer of CP

osun-demand-transfer-cp

Di All Progressives Congress, APC, for Osun State don demand di immediate transfer of Patrick Kehinde Longe, di CP Commissioner of Police.

Na during di press conference on Wednesday for Osogbo na hin di party make this matter known.

Di party accuse di Peoples Democratic Party, PDP, say dem sponsor hoodlums for di State.

Tajudeen Lawal, di Acting Osun APC chairman, yarn say dia members neva know peace since di Osun Gubernatorial election. This na since di petition tribunal judgment wey no favour di Osun PDP and Governor Ademola Adeleke.

Lawal bin mention say most of dia members for Atakunmosa East local government area of di State don run comot for di town and all dia properties dey wilfully destroyed by suspected PDP thugs. Hin tok say na plan to prevent them from taking part for di forthcoming general elections.

FOR MORE NEWS: 2023: Di man wey meet Tinubu no be our Kano guber candidate – Labour Party

Lawal cite di February 2, 2023, attack for Irewole Local Government Council Area where some thugs murder Saheed Oyegunju.

Also, di party reveal say dem dey armed with information wey reveal arrangements between di PDP for di State and di police to arrest some of di leaders.

Reacting, Akindele Adekunle, di Osun PDP caretaker chairman yarn say di CP Longe no dey biased in favour of di PDP as APC take claim.

Meanwhile, CP Longe on hin part don explain say he dey carrying out hin duties professionally and that di cases of attacks by political parties dey under investigation.

Speaking through di command spokesman, Yemisi Opalola, Longe give assurance say all cases go dey investigated and di culprits go dey brought to book.

You fit go read d full tori about Osun State demand for di immediate transfer of Patrick Kehinde Longe, di CP Commissioner of Police….READ MORE