fbpx
November 16, 2024

“Nigeria na laughing stock” – Pastor Giwa dey demand fresh presidential election

pastor-giwa-join-call-for-fresh-presidential-election-

Pastor Adewale Giwa don join di call for some quarters for a fresh presidential election in Nigeria.

Di head of Awaiting The Second Coming of Christ Ministry follow call for a regional system of government to tackle peculiar challenges.

Also, inside statement on Monday, Giwa yarn say as Christians worldwide celebrate Christ resurrection, “Nigeria must rise from di dead and lead by example”.

In addition, di cleric charge di judiciary say make hin “wake up” perform hin civic responsibilities. And di action go ensure transparency, justice and truth.

Giwa claim say some judicial officers don become “ tool in the hands of di executive”. And hin advise dem say make dem move to di side of di pipo.

FOR MORE NEWS:  Peter Obi no dey qualified to contest presidential poll – APC tell tribunal

Also, hin hope say dis time around, di judiciary go make history by ordering fresh election wey go determine di future of di Kontri.

Di statement yarn say a new presidential election go pacify “di good citizens wey dey vex with di conduct of di exercise.

You fit go read di tori wey Pastor Giwa join call for fresh presidential election…READ MORE