fbpx
December 22, 2024

Peter Obi dey face post election battles

peter-obi-post-election-battles

Since di February 25 presidential election, Nigerians dey wake up see one news or another concerning some of di most popular candidates. And part of di news na di post election battles wey Peter Obi dey face.

Also, one of di candidates wey dey reach headline news na Mr. Peter Obi, di Presidential candidate of di Labour Party, LP.

No be news again say some of di presidential candidates dey accused of embezzling public funds, trading in narcotics and money laundering.

But Peter Obi wey pipo call “Mr Clean ”, dey face different controversies, especially from members of di opposition camps.

In 2021, a Pandora Paper investigation claim say Obi operate foreign bank accounts and hin operated shell companies incorporated in tax havens to launder public funds and dodge taxes.

 

FOR MORE NEWS: Di Pains Wey You Cause Nigerians Go Haunt You – Sowore reject Buhari apology

 

Di Pandora Papers bin leak about 12 million documents wey reveal hidden wealth and tax avoidance by some of di world rich and powerful men.

Obi yarn say hin dey happy as nowhere inside di article accuse am of any form of corruption, whether in di form of diversion of public funds or in any other manner during and after hin stewardship as di governor of Anambra State.

Also, hin explain say di allegation touch more on tax avoidance and non-declaration of some jointly owned assets and e no claim say hin engage in unlawful business ventures at any time

However, these past months, high-profile allegations na hin dey on top Peter Obi wey hin supportersdey call, “go and verify.

You fit go read di tori of Peter Obi post election battles….READ MORE