fbpx
September 29, 2024

Obidient don tattoo Peter Obi for hin chest, netizens dey mock am

Obidient-tattoo-peter-obi-for-hin-chest-

Another video don dey make rounds for social media, and e capture di undying support for Peter Obi to become di president of Nigeria for di  2023 elections. Di young man ink tattoo of di presidential candidate Peter Obi for hin body, and hin flaunt am as hin president come February 25th, 2023.

 

However, di Obidient fan receive different reactions from Netizens. Also, most of di netizens question di logic behind that kain tattoo, dem dey wonder why hin tattoo Peter Obi name for hin chest.

FOR MORE NEWS: Viral News: Pastor dey pray make miracle money enter members bank accounts during crusade

Among di reactions, seuntreacts write: When I tok say these pipo no get sense and dem dey go too far, dem say I hate Peter Obi. Na bandwagon effect be this. Una dey carried away and una don already dey form cult following.

Another user @ukpeborfelix67 write, “Tomorrow when di guy no lift up to expectation you go find  another Miss wey go clean am comot from your chest. Shey you no see say you be coward and you no get single sense for your head. Na like this pipo behave 2015 to bring buhari to post say na him be di only one wey fit  make sun shine for night. Pipo dey do the same thing for this peter obi too. DI man sef no know you.

You fit go read di full tori...READ MORE