fbpx
December 23, 2024

2023 election: Some Elements for Presidential Villa dey work against Tinubu – El-Rufai

element-for-presidential-villa-want-make-tinubu-lose-el-rufai

Governor Nasir El-Rufai of Kaduna State don yarn say some elements for Nigeria Presidential Villa dey work against Bola Tinubu, di presidential candidate of di All Progressives Congress, APC.

Di governor also open up say those dem bin get dia candidate for di APC presidential primaries, but di candidate bin no win.

El-Rufai announce this matter on Wednesday as hin dey answer questions for Channels Television Sunrise Daily programme.

Although di governor tok say those individual elements dey hide behind President Muhammadu Buhari desire to do wetin hin think say e dey right.

According to wetin El-Rufai tok, hin believe say some elements for di Presidential Villa want make Tinubu lose di election because dem bin no get dia way. Dem bin get dia candidate, but dia candidate no win for di primaries.

On top di matter, hin give two examples like di petroleum subsidy, wey dey cost di country trillions of Naira. Hin tok say all of dem bin agree say dem go remove di fuel scarcity.

FOR MORE NEWS: “You no get anything to offer Nigerians” – Udom Emmanuel don reply Tinubu

In fact, hin tok say hin bin get discussion with di president and hin show am some reason why dem need to comot di fuel subidy.

Besed on hin explanation, hin ask say how person fit get capital budget of N200b for federal roads and then spend N2 Trillion on petroleum subsidy? According to am, na di  conversation wey hin get with di president be that for 2021 when di subsidy thing start to rise.

Also, di  second example na this currency redesign. According to am, pipo need to understand di President. Now, pipo dey blame di Governor of di Central Bank for di currency redesign, but No. Hin tok say di person wey dey behind everything na di Mr Buhari.

Hin tok say dem change di currency in secret with di view say dem wan catch pipo wey dey keep illicit funds.

To conclude, hin yarn say na very good intention. However, to do am now,  no make any political or economic sense.

You fit go read di full tori…READ MORE