fbpx
September 30, 2024

Sabinus don react to video of Tinubu wey raise hands when pipo dey sing national anthem

sabinus-reaction-to-tinubu-wey-raise-hand-during-national-anthem

Skit maker, Chukwuemeka Emmanuel Ejekwu, a.k.a Sabinus don react to viral video of di APC presidential candidate, Bola Ahmed TInubu wey dey raise hand when pipo dey sing di national anthem.

Remember say during di APC presidential rally for Rivers State, Tinubu make pipo dey tok after dem see am raise hin hands for air after person make call for pipo to sing di national anthem, Sabinus react to that clip.

Former governor, Adams Oshiomhole use style tap am gently before hin bring di hands down.

However, di video dey trend and he don make plenty social media users dey tok.

FOR MORE NEWS: “Women no dey post dia men online because other men go stop to give them money” – Influencer, Pamilerin don tok

Reacting, Sabinus enter hin Instagram page to express disappointment for di type of candidate wey dey carry head come front to be di next president of Nigeria.

Na wetin Sabinus write be this;

He wrote:

“A presidential candidate no know di proper way to stand during national anthem of di country wey hin wan lead? This one speaks volume. Make we continue to dey gamble with our future. Those people on that stage with him most of dia pikin dey schooling and live abroad. Very pathetic!”

You fit go see di full tori…READ MORE