fbpx
December 22, 2024

WAEC scratch card claim say Sanwo-Olu submit fake GCE result to INEC, Jandor don react

sanwo-olu-fake-gce-result

Di Peoples Democratic Party and dia governorship candidate, Abdul-Azeez Adediran (Jandor), don accuse Lagos state governor-elect, Babajide Sanwo-Olu say na fake GCE result hin get.

Also, dem submit petition before di Lagos governorship election petition tribunal. Dem dey ask di tribunal to disqualify Governor Babajide Sanwo-Olu and nullify hin governorship victory over di claim of fake GCE result.

FOR MORE NEWS: UCL: Tuchel to sign Man Utd target for Bayern Munich

According to di statement, dem discover say di statement of result wey dey issued by Ijebu Ife Community Grammar School, Ijebu-Ife for May/June 1981 GCE O’Level examination with examination number 17624/118, wey hin submit for hin first term election as governor of di state no dey confirmed by WAEC.

When JANDOR and PDP approach WAEC for confirmation, dem dey directed to buy di scratch card for verification of di WAEC result scratch card. Dat one kon confirm say di results no come from WAEC. E come back to be fake result.

You first go read di tori…READ MORE