fbpx
December 23, 2024

Shettima Advise North West Leader Make Dem Unite, Support Tinubu On Insecurity

shettima-call-political-leaders-for-north-west-region

Vice President Kashim Shettima don call on leaders for di North West region of di county make dem unite and support di present administration efforts in addressing challenges wey di pipo dey face.

He make di call yesterday for hin remarks when hin pay Sallah homage to di Sultan of Sokoto, His Eminence, Muhammad Saád Abubakar II, for hin palace

Also, hin yarn say President Tinubu dey aware of di challenges wey pipo dey face – hin dey aware of di insecurity and hin dey take  measures to address di situation.

Hin encourage political leaders make dem unite in order to confront di common challenges of insecurity, poverty and underdevelopment for di region.

 

FOR MORE NEWS: Biafra: Release Nnamdi Kanu, no be like Abacha, Buhari – Lawyer tell Tinubu

 

As hin dey pass President Tinubu felicitations to dem, di vice president inside statement by hin media office emphasize di importance of peace and unity. Hin mention say peace no fit dey without development, and development no fit dey without peace.

In addition, hin yarn say Tinubu administration acknowledge di role of traditional institution, and hin dey committed to giving di necessary support to contribute to di nation progress.

Shettima also task di state governor, Dr Ahmed Aliyu Sokoto, on providing purposeful leadership. Also, hin tell am make hin maintain cordial relationship with leaders across di State.

You fit go read di tori see wetin Shettima tok as hin call leaders for North West …READ MORE