fbpx
December 22, 2024

BREAKING: Supreme Court don adjourn new naira suit judgement

Supreme-court-don-adjourn-New-Naira-suit

Di Supreme court on Wednesday adjourn judgement for di New naira policy suit to March 3, 2023.

You fit remember say this new naira note matter bin enter court and di supreme court bin order di CBN and Federal government say make dem no ban di use of old naira notes.

However, during Buhari address to di nation on February 16, hin yarn say di deadline for old N500 and N1000 still remain, but pipo fit dey use di old and new N200 until April 10.

This matter don bring plenty tok from some governors and Politicians.

FOR MORE NEWS: Nyesom Wike dey plans to comot for Nigeria – Eze don reply PDP on Amaechi-Atiku link

Even di Governor of Kaduna bin yarn say citizens for hin state no go follow that order.

Di cash scarcity matter di dey ground and plenty pipo dey expect to hear wetin di judgement of di Supreme court go be.

Also, di latest update now be say di Supreme court don adjourn di new naira suit judgement until March 3.

More details dey come….READ MORE