fbpx
September 30, 2024

“I k!lled my boss, hin wife, and son over salary, loan” – Suspect don confess to crime

suspect-confess-to-crime

Lekan Akanbi, di prime suspect for di murder of a former employee of di Central Bank of Nigeria, Mr. Kehinde, hin wife, Bukola, and dia son on New Year’s Day for Ogun State, don confess to di crime.

Lekan, wey be di driver of di deceased family, as hin dey before newsmen on Friday, February 10, yarn say hin arrange di killing because di couple. This na because dem no gree increase hin salary and dem no grant am loan.

As di Suspect confess to di crime, he yarn say him and hin gang members kill di family after dem force them transfer N1,102,000.

According to am, hin start to work with di couple since di year 2010 without any salary increase, and hin don try to convince them plenty times say make dem increase hin salary, but all di attempt fail.

FOR MORE NEWS: “I go pepper all of una” – Skit maker, Nons Miraj don reply naysayers over new Range Rover Velar

Also, di suspect explain say hin invite di two others, Ahmed Odetola, a.k.a. Akamo, and Waheed Adeniyi, aka Koffi, make dem join am for di robbery.

He claim say contrary to reports wey tok say hin pick di couple from church after crossover night, in comot for dia house hours before di service and returned with hin gang to ambush them.

Lekan yarn say hin gang attack di couple immediately dem enter di house, and hin control di Alsatian dog wey dey di gate because hin dey familiar with di animal.

You fit go read di full tori…READ MORE