fbpx
December 23, 2024

“Peter Obi go fail you, hin deny Jesus 3 times” – Tinubu dey tell Anambra Citizens

tinubu-for-anambra-state-and-peter-obi-tok

Di presidential candidate of di ruling All Progressive Congress, Bola Ahmed Tinubu again don throw word for hin other counterpart, Mr Peter Obi of di Labour Party. Tinubu wey carry hin campaign go Peter Obi state,  Anambra state throw different word for di Labour Party’s bannerman. Remember say Peter Obi na di former governor of Anambra State.

According to clips from campaign rally wey dey make rounds for internet, Tinubu describe Peter Obi as man wey no go keep to hin campaign promises for Anambra State..

Tinubu yarn say just like we dey read for Bible, before c*ck crows three times, Peter deny Jesus Christ. Shey no be true? Hin deny!

“So how hin wan take keep hin promise to you?” All these things na wetin Tinubu tok for di campaign rally.

FOR MORE NEWS: 2023 election: Some Elements for Presidential Villa dey work against Tinubu – El-Rufai

Many political experts don yarn say Peter Obi na di closest rival to Tinubu for di forthcoming elections despite di national spread of di APC hard-work.

Some political fans also believe say Obi no get chance at all for di presidential race. However,  hin fit surprise and overtake strong candidates like Tinubu. Even di bannerman of di  Peoples Democratic Party (PDP), Alhaji Atiku Abubakar no safe.

Reports show say Tinubu don already det di support of almost 16 governors for di north. On top that one, all of dem don endorse hin presidential bid ahead of next month presidential polls.

You fit go read di full tori…READ MORE