fbpx
December 22, 2024

Tinubu dey rest for Europe ahead of May 29 inauguration – APC

tinubu-dey-rest-for-europe

Di All Progressives Congress (APC) on Thursday yarn say di President-elect, Bola Tinubu dey rest for Europe ahead of hin inauguration on May 29.

Mr Felix Morka, APC National Publicity Secretary, tok dis one on top Channels Television Politics Today programme.

According to Morka, Tinubu go swing to action immediately after he returns from Europe.

When dem ask am about di whereabouts of Tinubu, Morka yarn say “He Tinubu dey rest for Europe . Also, hin dey fine. After di elections and all of di energy wey hin use, hin just decide to take a moment of rest.

In addition, he tok say when he come back and he dey inaugurated on May 29, dulling no go dey.

FOR MORE NEWS: ‘Hidden agenda’ – Gov Ortom don call for suspension of 2023 census

Also, hin tok say Tinubu go dey loaded with di responsibility of running a country as massive and complex as Nigeria. However, hin know say Tinubu go soon come back to di kontri.

He add say na working rest because even for hin rest, he dey take time reach out to heads of government and other levels of leadership of other countries wey dey vital to di agenda wey hin dey  bring for hin new government.

“He’s not sleeping in his bed; he’s also in meetings regularly with all kinds of people who are travelling from other countries to see him preparatory to his inauguration. So, it’s a working visit.” Na wetin Morka tok be dat.

Tinubu win di February 25 Presidential election and hin bin dey declared di President-Elect by INEC.

You fit go read di tori…READ MORE