fbpx
December 22, 2024

Tinubu wan reward Wike with ministerial appointment for rigging polls – Atiku aide claim

tinubu-wan-reward-wike

Phrank Shaibu, di Special Assistant on Public Communication to di 2023 Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar, don accuse President Bola Tinubu say hin wan reward di immediate past Rivers State Governor, Nyesom Wike with ministerial appointment.

Shaibu yarn say ministerial appointment na to appreciate Wike for rigging di presidential election for Rivers State to favour Tinubu.

He insist say di results for states like Rivers show say di last presidential election dey far from credible.

Inside statement wey hin sign, Shaibu yarn say e dey tragic say Tinubu dey plan on rewarding Wike with ministerial portfolio despite di pending petition against di former Governor wey attract nearly 300,000 votes.

 

FOR MORE NEWS: “This na dream come true” – Asake don tok as hin prepare for hin O2 Arena concert

 

Na wetin di statement read in part dis: “Di Presidential election for Rivers State na cleat ojoro as evidence by wetin INEC upload on IREV.

“So far, nearly 300,000 Nigerians don sign petition on change.org wey demand visa bans against Governor Wike.

“Tinubu now dey plan to appoint Wike as minister as a reward for dat disgraceful election.

Di statement tok say na shame. And dis na character wey claim to fight for di actualisation of June 12?

You fit go read di tori see di tori as Tinubu wan reward Wike…READ MORE