fbpx
September 29, 2024

“You no get anything to offer Nigerians” – Udom Emmanuel don reply Tinubu

udom-emmanuel-don-reply-tinubu

 Governor of Akwa Ibom State, Udom Emmanuel, don reply di presidential candidate of di All Progressives Congress, Bola Tinubu.  Hin yarn say Tinubu dey always abuse and insult pipo during campaigns. Thi na because he no get anything to bring come table for Nigerians. Na on Monday di government give this reply.

Although he yarn say even as di former Lagos State Governor insult am, hin go allow peace to reign. Udom Emmanuel for hin reply yarn say hin go ignore all di insults wey Tinubu give am.

According to am, di thing wey hin go focus on na to help install good governance wey go rescue Nigerians from dia present sufferness.

FOR MORE NEWS: Osun: “This na victory of light over darkness” – Tinubu don react to Adeleke sack

Emmanuel talk on Monday evening for Government House, Uyo. This na as hin dey inaugurate di newly appointed Permanent Secretaries, Chairmen and Members of Boards and Commissions. As well as Transition Committee to ensure di smooth transition of power to di next administration.

Remember say for di rally wey Tinubu host for Uyo on Monday afternoon, hin bin talk some kain thing about Governor Udom Emmanuel.

Hin tell dem for “Akwa Ibom say that boy wey bring Atiku come there, wey de call himself Governor, tell am enough is enough! Hin de live for my backyard for Lagos, If no be say we be one, I for don send am comot go house. You see that mansion wey hin dey live, I go just use lizards, pigeons and scorpions to put am inside.

You fit go read di full tori…READ MORE